"Confusion Pt. II" lyrics - FELA KUTI

FELA KUTI
"Confusion Pt. II"

When we talk, say confusion
Everything out of control
When everything out of control
He go say he pafuka

When we talk, say confusion
Everything out of control
When everything out of control
He go say he pafuka

Dem be three men wey sell for roadside-o
Dem three speak different language-o
Dem speak Lagos, Accra, and Conakry
One white man come pay them money-o
He pay them for pounds, dollars and French money-o
For the thing wey he go buy from them
He remain for them to share am-o
Me I say, na confusion be that-o
He go say he pafuka o

Before-before Lagos traffic na special, eh
Number one special all over the world
You go get Ph.D. for driving for Lagos, eh
You go get M.A. for driving for Lagos, eh
You go get M.Sc. for driving for Lagos, oh
For me for me I like am like that, eh
Ah-ha-ha-ha, na my country - why not?
For me for me I like am like that, eh

For Ojuelegba
For Ojuelegba
For Ojuelegba
For Ojuelegba (Lagos City)
For Ojuelegba
For Ojuelegba
For Ojuelegba
For Ojuelegba, moto dey come from south
Moto dey come from north
Moto dey come from east
Moto dey come from west
And policeman no dey for centre
Na confusion be that-i o
He go say he pafuka o

When we talk, say confusion
Everything out of control
When everything out of control
He go say he pafuka